Nigeria Police news

6 Results / Page 1 of 1

Background

National

IGP Wire Commissioners Of Police To Check Tools

By: Esther Ayoola Oga Inspector General of Police, Tunji Disu, like dis don send order to all stations across di obodo Naija to check all dia working tools make wetin hapun for Delta nor repeat imself. Im yan dis one during a meeting with senior officers in Abuja on Tuesday. Disu clear im Commissioners of Police to conduct proper check of all dia tools. Dis sef dey come afta a […]

todayMay 5, 2026 13

National

Police Arrest 29-Year-Old Ondo Man, Say Im Hide Human Bones For House

By: Esther Ayoola Police for Ondo State police command don do Rambo arrest one 29-year-old man, Awomehinde Tope, for Ile-Oluji area after allegation say im go thief im papa property. Police tuk, tuk person, Abayomi Jimoh, naim dey convasate dis mata  say di reason for di arrest be say, di suspect allegedly carry away tins like motorcycles, goats, palm oil, phones, gas cylinders, gold items and rugs from im father. […]

todayApril 24, 2026 11

National

Oyo Police Gbab 3 Jaguda Boys Say Dem Be Suspected Kidnappers

By: Esther Ayoola Oyo State Police command do small James Burn arrest three suspected kidnappers wey dem link to di kidnapping of one woman, Marian Remi, for Ido Local Government Area. According to statement by police tuk, tuk, Olayinka Ayanlade, Di suspects, Musa Ajibola, Hassan Mohammadu, and Umaru Hassan, dem catch dem on April 21 for Latayo Farm Settlement, Ile-Idu, after pipo give police correct intelligence informate. Police tuk say, […]

todayApril 24, 2026 12

National

Ondo Police Gbab Six Allege Fake Pastors For Fake Miracles

By: Esther Ayoola Ondo State Police Command say dem don gbab six men dat dem sell miracle for Idanre LGA, dey pose as pastors, dey do fake miracles up and down. Police tuk, tuk, Jimoh Kazeem, say di arrests happen on February 16, 2026, afta tactical team and Community Safety Officers follow intelligence. Police say, di suspects, wey dem identify as Fadahunsi, Kolade, Tijani, Iyanuoluwa, Arijesulola and Ademola, dey do […]

todayFebruary 27, 2026 13

Uncategorized

Lagos CP Make Correct Move, Promote 35 Senior Police Officers

By: Rilwan Agbomeji Di Lagos State Police Commissioner, CP Olohundare Jimoh, unto betterlicious doings don promote 35 senior officers to help make security for di state. Thirty superintendents don become chief superintendents of police (CSP), while five DSPs don become SPs Tuk tuk of di Lagos state police command, SP Abimbola Adebisi, clear tori pipo say, say di promotion show how di Inspector-general of police dey reward hard work and […]

todayDecember 31, 2025 28

National

Police Talk Say Dem No Force Officers To Buy ₦2,000 Handbook

Di Nigeria Police Force don deny tori wey dey fly say dem force dia officers for all over di country to buy one handbook wey dem call “Attitudinal Change Handbook for the Nigeria Police Force” for ₦2,000 per person. One online report bin talk say police authorities give order make all personnel pay di money before Thursday deadline. But one document wey surface on Monday show say di approval come […]

todayNovember 4, 2025 59

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds