By: Esther Ayoola
Residents of Aina Aladi Community Development Association for Alagbado, Lagos, tuk say dem dey suffer oh, serious blackout because of faulty transformer.
Community leader, Afeez Lawal, naim carry dis mata dey yarn tori pipo on Saturday, Say dem carry mata to Ikeja Electric office, no response.
E explain say di transformer misbehave for about three years before e finally break down for December 2025, wey leave over 300 houses without light.
Say, how dem wan take repair di transformer, dem nor know, with no clear date, Aladi community dey beg relevant authority to come to dia aid.