US Presido, Donald Trump don announce new naval mission wey dem call “Project Freedom”, to escort stranded ships comot from Strait of Hormuz.
Iranian lawmaker Ebrahim Azizi say if U.S enter di strait, dem go see am as breach of ceasefire agreement.
Say like dis, Iran Foreign Ministry still dey look di response wey dem receive from Washington on dia new 14-point plan to end di war.
Trump bin already tuk say di Iranian proposal nor join at all, however say, di ship guiding for di strait of Hormuz go start in di next few hours.