Bola Ahmed Tinubu don give urgent order say all Nigerian missions for South Africa must set up emergency crisis unit sharp-sharp to protect Nigerians wey dey face threat.
Dis one dey for inside statement wey di Foreign Affairs Minister drop on Thursday.
According to Foreign Affairs Minister, Bianca Odumegwu-Ojukwu, she say wetin dey happen for South Africa pass ordinary xenophobia, say e don turn full “Afriphobia.”
She still tuk say Nigerians suppose call security authorities for help any time gbege burst.