By: Jolayemi Olajide
Wi oga Presido, Bola Tinubu, AKA baba seyi don arrive Nairobi, Kenya, ahead of the Africa-France Summit wey go start later on Monday.
State House media office tok say di Airbus A330-200 wey carry Tinubu land for Jomo Kenyatta International Airport around 12:15 a.m. local time after him leave France for di second leg of im three-country tour.
During him visit to France, Tinubu meet global investors and promise say Nigeria go continue with fiscal discipline and economic reforms.
Di Africa-France Summit, wey French Presido Emmanuel Macron and Kenyan Presido William Ruto co-chair, go focus on energy transition, green industrialisation, digital transformation, climate action and beta financing for Africa.