By : Jolayemi Olajide
Dangote Reject NNPCL Bid To Increase Stake for Refinery as Fuel Supply RiseBaba Presido of Dangote
Group, Aliko Dangote, don reveal say dem reject request from Nigerian National Petroleum Company Limited (NNPCL) to increase dia 7.25 percent stake for Dangote Petroleum Refinery
Im yarn dis one during one interview wey happen on Wednesday with news pipo.
Di billionaire businessman say im company nor dey change ownership patterns, even as di $20 billion refinery for Lekki, Lagos continue spread like virus for di Nigeria fuel market.