By: Jolayemi Olajide
Wi oga Presido, Bola Tinubu (don open naija economy for ground waaa) don clear mata oh, say like dis now, Nigeria fit attract nearly $20 billion foreign direct investment for 2026, based on say na sabi pipo dey run matas for di gorment.
Tinubu yarn dis one on Thursday during Africa CEO Forum wey shelle for Kigali.
Baba Seyi also explain say gornment don put beta benefits for ground to encourage more foreign businesses and investors make dem bring money come Nigeria.