By: Esther Ayoola
Ogun State Gornment don warn one big police oga for Force Intelligence Department Abuja, AIG Enyinnaya Adiogu, to stop di double touch lighting wey im dey do on top one land case wey connect one Church for Sango-Ota.
Inside one letter wey date May 23, di Ogun State Attorney General and Commissioner for Justice, Oluwasina Ogungbade, tell di AIG make he hands-off di mata since di land case already dey court.
One-man wey high-court name as Ibrahim Gbenga Ibuoye na im carry di mata go give di police, but di goment tuk say di same man dey face case for magistrate court for Abeokuta on top say he enter another person land with force and use violence.
Ogungbade explain say since court already dey handle di mata, make police stop to dey do another investigation for back so dat dem no go scata di work wey di judge dey do.