OGUN STATE

15 Results / Page 1 of 2

Background

OBODO NAIJA

Police Arrest 22-Year-Old Man For Suspected Defilement Of 15-Year-Old Girl

By: Mariam Ajayi Police don arrest 22-year-old Daniel for Ogun State over allegation say e drug 15-year-old girl with malt drink before e allegedly defile her. Force spokesperson Ani Iniedu confirm di arrest in a statement on Sunday, saying di girl lose consciousness after she drink di malt. Police take di victim go Olukoye Ransome-Kuti Memorial Hospital for Asero for medical check-up, while dem carry di suspect go custody.

todayAugust 31, 2026 11

Lagos

Truck Kill Man For Lagos-Ibadan Expressway, Driver Run

One yet-to-be-identified young man die for Lagos-Ibadan Expressway near OPIC bus stop, Ogun State, on Wednesday after speeding truck hit am as e dey cross road. Witness Nojeem say di truck run over di man and di driver run away, while di crash scatter parts of im body for di road and affect traffic. Media toktok person Babatunde Akinbiyi confirm di incident and say some officials and Amotekun Corps move […]

todayAugust 20, 2026 12

OBODO NAIJA

Three People Kpai as Crane Jam Truck for Sagamu-Benin Expressway

By: Esther Daniel Three pipo kpai and three others sustain wujuries after one crane collide with one truck for Sagamu-Benin Expressway, Ogun State, on Wednesday morning. Traffic Compliance and Enforcement Agency for Ogun State, TRACE, tuk, tuk person, Babatunde Akinbiyi, tok say di crane dey drive against traffic at high speed before di crash happen. Rescue teams from TRACE, FRSC and Police carry di wujured go Babcock University Teaching Hospital […]

todayAugust 5, 2026 9

south west

Three kpai As Two-Storey Building Collapse For Ogun

By: Esther Daniel At least three pipo naim dem don konfam say kpai after one two-storey building collapse gbuaii for ground inside Baale Road, Ajuwon area of Ifo Local Gornment Area for Ogun State. South-West Zonal Director of NEMA, Saheed Akiode, naim use im yamchop mouth dey konfamate dis badness say dam sha rescue 12 pipo alive from di rubble. Akiode say dem go bring down di remaining part of […]

todayJuly 28, 2026 11

OBODO NAIJA

Ogun State King Back Adebutu for 2027 Ogun Gofnorship Race

Senior man Alake and Paramount Ruler of Egbaland, Oba Adedotun Gbadebo, don publicly support PDP gofnorship candidate, Hon. Oladipupo Adebutu, ahead of di 2027 Ogun election. Oba Gbadebo give im support  when Adebutu and im campaign team visit di Egba Traditional Council to collect  royal Avian. Di monarch praise di Adebutu family, describing dem as people wey get long history of generosity and commitment to Egbaland development.

todayJuly 20, 2026 11

south west

Ogun State Extend Work Break And To Pay ₦10,000 Transport TFare For Workers

By: Esther Daniel Ogun State Govo, Dapo Abiodun, don approve make di one-day-off-duty work palliative for eligible public and civil servants continue for di state. Di govnor put dis one or news statement give news tatafos for Ogun state. According to di govo Abiodun, di measures na to reduce di burden of transportation costs on workers and encourage dem to continue providing efficient and quality service to di people of […]

todayJuly 17, 2026 17

south west

Ogun Police Gbab Two Suspected kidnapers

By: Emmanuel Ariyo-David Operatives of Ogun State Police Command don go kpai two suspected kidnappers and recover gun, cash and other items during one follow-up operation linked to di rescue of one kidnapped victim. Police talk say na officers from di Anti-Kidnapping Unit carry out di operation as part of efforts to fight kidnapping and other violent crimes for di state. According to statement wey police spokesman DSP Oluseyi Babaseyi […]

todayJune 24, 2026 10

south west

Ogun Gorment Set Up Committee To Secure Schools

By: Esther Ayoola Ogun State Gornment don decide oh say dem nor wan hear dem shoot bird mama fly, like dis don set up security Committee to tackle jaguda boys for schools. Na oga Commissioner for Education, Prof. Abayomi Arigbabu, naim carry dis mata tuk give tatafo, say di committee go hellep improve safety, emergency response and beta learning environment for students and teachers. Di senior man commissioner explain say […]

todayJune 9, 2026 8

south west

Ogun People Come Out Protest Oyo School Kidnap

By: Esther Ayoola Residents for Ogun State don come out for Abeokuta streets do wey nor go gree sake of insecurity and di kidnapping of 39 school children plus seven teachers for Ogbomoso, Oyo State. Di protesters, wey include youths and nursing mothers, carry placards dey demand make gornment act fast to rescue di victims and stop kidnapping, banditry and terrorism. Dem say na children wey nor commit any crime, […]

todayJune 2, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds