By : Jolayemi Olajide
Israeli air strikes don go kpai at least 11 pipo and wound 15 others inside eastern Lebanon, as the small peace agreement between them dey face big trouble.The attack block di village of Mashghara inside Bekaa Valley on Monday night, and Lebanon government news konfam say everywia scatter.Prime Minister Benjamin Netanyahu tuk say im give order make army drop heavy bomb join after Hezbollah pipo do dia own attack.Now, the Israel military kon talk say dem smash pass 100 places wey Hezbollah dey hide put property and weapon across southern Lebanon.