Israeli army don go kpai at least 31 pipo and wunjure 40 others for southern Lebanon on Tuesday, say dem launch heavy air and ground attacks across di area.
Dis na according to Lebanese health officials, say Israeli military also warn residents for several towns and villages for southern and eastern Lebanon make dem commot immediately.
Dat dem ma take down all Hezbollah fighters, like say dis fighters nor be pipo papa.
Dis attack don cause serious panic as thousands of pipo don dey gbese while Israeli ground troops dey push deeper enter Lebanese territory.