OBODO NAIJA

Teachers For Lagos Storm Street, Demand Freedom For Kidnapped Teachers And Students

todayJune 2, 2026 6

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Teachers for Lagos State sef don join di nationwide protest, for dis Oyo school children kidnap.

Dem carry di wahala  go Lagos State House of Assembly for Alausa, demanding, say gorment gat raise body for di mata, everyday kidnapping kidnapping say dem don tire.

Di protesting teachers, under di Nigeria Union of Teachers, trek from Ikeja Under Bridge,  raise dia  voice  dey shout abeg oh rescue our children for us.

Lagos NUT Chairmo,  Akintoye Hassan, even dey di protest ground  and im explain say di  protest no be only because of the recent Oyo kidnapping incident but to call attention jaguda boys doings across di obodo Nigeria.

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds