National

How 13 Reps Members Switch Party For House As Dem Resume Work

todayJune 3, 2026 2 2

Background
share close

By: Esther Ayoola

As House of Representatives resume from four-week break on Tuesday, na 13 lawmakers announce say dem don change political parties.

Speaker Abbas Tajudeen read di defection notices during plenary, with lawmakers from Nasarawa, Cross River, Edo, Katsina, Oyo, Delta and Bauchi states joining different parties.

Most of di lawmakers wey defect say internal crisis, leadership quarrel and factional divisions for dia former parties naim be di reason wey push dem to move go new political platforms.

Dem also argue say di problems for dia former parties dey affect dia ability to properly represent di interests of dia constituents.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds