National Assembly

14 Results / Page 1 of 2

Background

OBODO NAIJA

Reps Extend 2025 Budget Capital Projects Deadline Till December

By: Mariam Ajayi House of Representatives don approve another extension for di deadline to complete capital projects and spending under di 2025 Appropriation Act, moving am from September 30 to December 31, 2026. Di extension follow request from Presido Bola Tinubu to National Assembly, make ministries, departments and government agencies get more time to finish ongoing infrastructure projects and other capital spending for di 2025 budget. Na di fourth time […]

todaySeptember 29, 2026 13

National

National Assembly Go Translate Laws Into Igbo Hausa Yoruba

By: Kofoworola Olayinka National Assembly Library Trust Fund say dem go soon translate Naija laws into Igbo, Hausa, Yoruba and other local languages to make legislative information easier for Naija pipu to understand. Executive Secretary of di Fund, Henry Nwawuba, yarn dis on Monday for Abuja during di 2026 National Assembly Library Week. Nwawuba say dem also dey upgrade di e-library and develop mobile app plus Bills Tracker wey go […]

todaySeptember 29, 2026 10

OBODO NAIJA

Federal Workers Demand N300k Minimum Wage

By: Mariam Ajayi Na Federal Workers Forum write Presido Tinubu and National Assembly, ask make dem increase minimum wage from N70,000 to N300,000. Di group say N70,000 no fit meet workers’ needs because cost of living don high. Dem also want Level 17 officers to earn up to N1.5 million, while urging government to pay outstanding consequential adjustments. Di workers say dem need urgent action to prevent hunger and hardship.

todaySeptember 3, 2026 22

OBODO NAIJA

Senate Say State Police Bill Work No Go Stop

By: Esther Daniel Di Senate don assure Nigerians say work on State Police Bill no go stop despite National Assembly recess. Senate spokesman Yemi Adaramodu tok say committees still dey work to harmonise di bill with House of Representatives. According to am, di recess no go delay di constitutional amendment process. Di bill don get support from gofnors, state assemblies and oda stakeholders wey want better security.  

todayAugust 5, 2026 16

OBODO NAIJA

House of Reps Pass State Police Bill

By: Yusuf Abuh House of Representatives on Thursday for Abuja don approve di State Police Constitution Amendment Bill. But dis one na after beta jogolo from some members of di minority caucus wey dey protest say di bill need beta okporlor eyes to look am wella. However, Deputy Speaker and Chairman of House Committee on Constitution Review, Benjamin Kalu, sti press hand for di bill, say di bill na one […]

todayJuly 24, 2026 14

OBODO NAIJA

ADC Question Tinubu Fitness, Raise Alarm Over Gornment Appointment Wahala

By: Esther Daniel African Democratic Congress (ADC) don raise alarm over wetin e describe as appointment wahala for Presido Bola Tinubu administration. Di party say National Assembly suppose investigate whether di Presido still dey fit to perform di duties of im office. According to statement wey National Publicity Secretary, Bolaji Abdullahi, sign, one man wey presidential directive remove from office still dey occupy di position and hold meetings with top […]

todayJuly 17, 2026 27

OBODO NAIJA

Akpabio Vex After Mic No Gree Work Well

Senate Presido, Godswill Akpabio, don threaten legal action against contractor wey renovate National Assembly complex because microphone dem for Senate and House of Representatives chambers no gree work well. Akpabio tok dis one during Wednesday plenary after plenty senators struggle to use microphone as dem dey contribute for debate. E show say di matter dey vex am well well, as e talk say di constant microphone problem don become disgrace […]

todayJuly 16, 2026 22

OBODO NAIJA

 Naija Senate Clear Im State Assemblies Why Dem Need Pass State Police Law

By : Jolayemi Olajide Di National Assembly dontigthen every every as e take concern security for obodo Nigeria, say make all di 36 State Houses of Assembly to quick-quick approve di bill for state police. Dis move follow di efforts wey oga Presido Bola Ahmed Tinubu make to spread policing power to hellep fight jaguda boys Di lawmaker press yans, say true, true, Nigeria need state policing. Senate come commend […]

todayJuly 8, 2026 21

OBODO NAIJA

News House of Representatives scata as lawmakers clash to summon President Tinubu

By : Jolayemi Olajide Di House of Representatives bin turn to warzone on Wednesday after lawmakers quarrel sake of one motion wey dey ask make President Bola Ahmed Tinubu come explain him side for di Green Chamber. Benedict Etanabene wey be lawmaker for Delta State bin raise di issue because of one circular wey di Accountant-General Shamseldeen Ogunjimi send out on June 29. Etanabene argue say di matter too serious […]

todayJuly 8, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds