By: Esther Ayool
Federal Gornment don tighten Ebola check for airports, seaports and land borders across Naija to stop di virus from entering.
Assistant Director Naija body mata pipo, Ado Bako, tuk say Naija never record any confirmed case yet.
Ministry of Health yarn say travellers wey show symptoms or dem mark as high-risk go face extra screening, isolation and referral.
As elders dey tuk, “better to close door before thief enter,” so gornment don act quick because of di Bundibugyo strain outbreak for East and Central Africa.