Ebola outbreak

8 Results / Page 1 of 1

Background

obodo oyinbo

Pope Leo XIV Beg International World Pipo To  Congo Fight Ebola

By: Mariam Ajayi Pope Leo XIV don call on di international community make dem join hands help Democratic Republic of Congo fight Ebola disease. Di Pope make dis call on Sunday after im Angelus prayer for St Peter’s Square, as e urge local communities to also join di effort to save lives. He say di suffering wey Ebola don cause for Congo serious, and e don worry am say instead […]

todayAugust 24, 2026 9

obodo oyinbo

Ebola Outbreak Don Become DRC Deadliest Ever

World Health Organisation, WHO, say di Ebola Bundibugyo outbreak for Democratic Republic of Congo, DRC, don kill 2,325 people, making am di deadliest Ebola outbreak di country don ever record. WHO tuk dis one on Monday, saying di number don pass di 2,299 deaths wey dem record during di 2018 to 2020 outbreak. Di outbreak wey gornment declare on May 15 don record 4,945 confirmed cases, while 730 people still […]

todayAugust 18, 2026 14

Sports

Ebola Scare Shake Dr Congo World Cup Prep

By: Esther Ayoola Democratic Republic of Congo dey fall hand oh, losing 2–1 to Chile for friendly match wey dem play for France on Tuesday, put am for Ebola head Di match suppose hapun for southern Spain, but di mayornor gree based on Ebola concern, naim make dem con move go France, and now dem con lose World Health Organization don declare international health emergency over di Ebola outbreak wey […]

todayJune 10, 2026 12

National

FG Tighten Ebola Check For Airports, Borders And Seaports Across Naija

By: Esther Ayool Federal Gornment don tighten Ebola check for airports, seaports and land borders across Naija to stop di virus from entering. Assistant Director Naija body mata pipo, Ado Bako, tuk say Naija never record any confirmed case yet. Ministry of Health yarn say travellers wey show symptoms or dem mark as high-risk go face extra screening, isolation and referral. As elders dey tuk, “better to close door before […]

todayJune 3, 2026 18

obodo oyinbo

Good News for DR Congo as Five Ebola Patients Recover

By : Jolayemi Olajide Five Ebola patients for DR Congo don recover and dem don discharge dem  from hospital as health workers dey continue doings to control di outbreak. Health officials say the recovery na sign  say if patients quick receive treatment, dem go survive di  Ebola. Dis latest  outbreak  don cause about 250 deaths according to tatafo, but authorities dey sti  try reduce di damage for congo.

todayJune 2, 2026 16

obodo oyinbo

By : Jolayemi Olajide World Health Organization officials on Tuesday don warn say Ebola outbreak for north-eastern DR Congo dey spread faster than dem first think. Dr Anne Ancia of WHO tell newsmen say as dem dey investigate more, dem dey discover fresh cases for different areas around Ituri province, wey be di centre of di outbreak. Residents for di area talk say na so pipo dey die, die anyhow, […]

todayMay 19, 2026 15

obodo oyinbo

UN Raise Alarm As Ebola Outbreak For Congo, Uganda Turn International Emergency

By : Jolayemi Olajide United Nations don beg countries and international organisations make dem quickly increase support for Ebola fight and humanitarian help for Democratic Republic of the Congo. UN tuk, tuk, Stephane Dujarric talk dis one on Monday for New York as e dey give update about Ebola outbreak for Congo and Uganda. According to World Health Organization, di Ebola outbreak don turn international public health emergency because of […]

todayMay 19, 2026 15

Health

Ebola Outbreak Hit Eastern DRC As Health Authorities Raise Alarm

By : Jolayemi Olajide Di Africa Centres for Disease Control and Prevention (Africa CDC) don konfam fresh outbreak of Ebola virus for eastern part of Democratic Republic of the Congo, on Friday. Say like dis, di disease don kpai some persons. Reports show say about 246 suspected cases and 65 deaths don already record, while 4 deaths don also happen among laboratory-confirmed cases. Africa CDC say di outbreak dey centered […]

todayMay 15, 2026 30

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds