By: Esther Ayoola
Wi oga President Bola Tinubu don ready to scatta mouth with the National Assembly join-together address di country for 2026 Democracy Day.
Di Inter-Ministerial Committee wey dem start on Tuesday tuk say other correct activities like Juma’at prayers, church service, and public lecture go also shele before di main day reach.
Inside di program, special youth and women events go hold on June 10, then di Presido go do im personal broadcast and Gala night to wrap everything up on June 12.