By : Jolayemi Olajide
Federal High Court for Abuja don sentence four guys to death by hanging because of the deadly attack wey dem do for Saint Francis Catholic Church for Owo, Ondo State.
Justice Emeka Nwite convict di four bad boys on Wednesday after the judge see say di evidence wey DSS bring clear wetin nor good, say dem be part of di terrorist group wey commit the crime.
Di convicts, Idris Abdulmalik Omeiza, Al Qasim Idris, Jamiu Abdulmalik, and Abdulhaleem Idris, stand trial for inside court based on how dem kpai over 40 church members and wound plenty others on June 5, 2022.
Inside di five people wey dem change for the case, di judge release and clear one man wey im name na Momoh Otuho Abubakar say im hand no dey the matter.