By : Jolayemi Olajide
Oyo State Gornment don pull down di building wey kidnappers use hide Olaide Adegoke John-Paul, sister to former Power Minister Bayo Adelabu, and her twin pikins.
Di demolition happen on Monday, less than two days after police rescue di woman and her pikin dem from di kidnappers.
Gornment tok say dem discover say na for di building di criminals keep the victims during dia captivity.
Authorities say di action show say Oyo State no go tolerate kidnapping and any other criminal activities.