By : Jolayemi Olajide
Former Vice Presido, Atiku Abubakar don send im condolence message to di Director-General of di World Trade Organization (WTO), Dr. Ngozi Okonjo-Iweala, after her younger brother, Prince Ikechukwu Okonjo, kpai.
Inside one post on top im X account on Monday, naim Atiku take salutate di former Nigeria finance minister and her entire family over di painful loss wey hit dem.
Atiku describe di late Prince Ikechukwu as a respected member of di Umu Obi Obahai royal family of Ogwashi-Uku kingdom inside Delta State before im go die dis die so.
Di former VP pray make God give Dr. Ngozi and di whole Okonjo family di heavy strength to bear di bad market as dem dey mourn dem beloved brother.