Sports

Okocha Collect Special FIFA Award

todayJune 12, 2026 8

Background
share close

Super Eagles legend Augustine ‘Jay-Jay’ Okocha don collect one special “Superior Player of the Match” award from FIFA for im beta doings against Spain wey im show for di 1998 World Cup.

Di award, wey Michelob ULTRA and Copa90 collabo give am, na to honor players wey show dem-sef for World Cup games before di official Player of di Match award start for 2002.

Di senior play naim post for Instagram, showing di silver trophy and tank di organizers for di big respect, even though years don pass.

Meanwhile, match day one dey continue to day for di World cup with Canada playing Bosnia by 8pm den USA go play Paraguay by 2am.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds