FIFA

16 Results / Page 1 of 2

Background

Sports

FIFA Accuse UEFA of Misinformation Over World Cup Deal

By: Kofoworola Olayinka FIFA don accuse UEFA of running misinformation campaign as UEFA dey try force FIFA release documents about Gianni Infantino plan to sell part of World Cup business. For court case for Florida, FIFA tuk say UEFA attempt to get di documents fit also be move to influence next year FIFA presidential election. Infantino proposal for July to create commercial company wey private investors fit buy stake inside […]

todaySeptember 29, 2026 10

Sports

FIFA Accept NFF Oga Dem Quit Notice

By: Mariam Ajayi FIFA don finally collobi letter from NFF big ogas for Switzerland, as dem promise to join bodi with Naija to reset wi local football. NFF image-maker, Dr Ademola Olajire konfamate di development Tuesday, as Sports Commission oga, Shehu Dikko lead delegation go FIFA House for Zurich link up with FIFA Presido Gianni Infantino. Dikko and im team, including Bukola Olopade, Dr Emmanuel Ikpeme and lawyer Okey Obi, […]

todaySeptember 2, 2026 13

Sports

UEFA Fire Warning Shot At Infantino Over FIFA World Cup Sale Plan

By: Esther Daniel UEFA don threaten FIFA Presido Gianni Infantino with legal action and warn am say make nobody destroy any document about di controversial plan to sell shares in FIFA competitions. Di  matter burst after reports show say FIFA wan sell part ownership of tournaments like men and women World Cup plus Club World Cup under one plan wey dem call FIFA Forward Enterprise. UEFA, together wit CONCACAF and […]

todayAugust 3, 2026 16

Sports

FIFA Boss Infantino Receive Heavy Blow As Top Adviser Quit Over World Cup Deal

By: Esther Daniel FIFA Presido Gianni Infantino don suffer big setback as him senior adviser Carlos Cordeiro resign on Friday over plan to sell part of di World Cup business operations. Cordeiro, wey be former US Soccer Federation president, talk say he no fit support di move because he believe say di deal no good for football. Di former banker and lifelong football fan explain say him decision come because […]

todayJuly 31, 2026 18

Sport Yarns

Norway Football Chief Plan To Report FIFA Over Folarin Balogun Ban

By :Jolayemi  Olajide  Norway football president Lise Klaveness talk to The Times inside Norway on Thursday say dem go report FIFA ethics committee over di suspension of Folarin Balogun World Cup ban, as dis action don put di whole game for risk. Di NFF boss make dis declaration during interview, happening because di controversial lifting of di ban suppose not happen for international football. Di board plan to meet and […]

todayJuly 23, 2026 21

Sport Yarns

FIFA say stability fit carry Super Eagles to 2030 World Cup

By: Jolayemi Olajide FIFA don siddun tuk say Nigeria get everything wey e need to qualify for di 2030 FIFA World Cup, but say stability go decide whether Super Eagles go make am. Di world football body say although Nigeria get plenty talented players, success for di next qualifiers go depend more on stable planning than ability. Super Eagles miss di last two World Cups after dia 2026 qualification campaign […]

todayJuly 22, 2026 15

Sports

FIFA Pick Vinčić to Officiate Spain vs Argentina Final Showdown

By: Esther Daniel Slovenian referee Slavko Vinčić go dey handle di big stage on Sunday as FIFA pick am to officiate di 2026 World Cup final between Spain and Argentina. Di 46-year-old go become di first Slovenian referee wey go take charge of a World Cup final and di 23rd official for history to get di honour. FIFA Chief Refereeing Officer, Pierluigi Collina, give Vinčić di news during an emotional […]

todayJuly 17, 2026 22

Sports

UEFA Drag FIFA Say Why Dem Do U-turn For Balogun Ban

By: Yusuf Abuh UEFA don accuse FIFA, wahyooo don dey inside di world cup oh say why dem go suspend Folarin Balogun one-match ban for one year. Dat one mean say, Balogun go play for USA World Cup Round of 16 match against Belgium. FIFA take di decision after US President Donald Trump intervene for di matter, and di move don spark plenty argument. UEFA  say FIFA cross di red […]

todayJuly 6, 2026 14 3

Sports

Okocha Collect Special FIFA Award

Super Eagles legend Augustine ‘Jay-Jay’ Okocha don collect one special “Superior Player of the Match” award from FIFA for im beta doings against Spain wey im show for di 1998 World Cup. Di award, wey Michelob ULTRA and Copa90 collabo give am, na to honor players wey show dem-sef for World Cup games before di official Player of di Match award start for 2002. Di senior play naim post for […]

todayJune 12, 2026 32 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds