Sports

Japan Snatch Late Draw As Dem Hold Netherlands

todayJune 15, 2026 7

Background
share close

Japan show strong fighting spirit for di FIFA 2026 world cup, coming back twice to force Netherlands play 2-2 draw for dia openingĀ  match for Texas on Sunday.

Netherlands captain Virgil van Dijk naim score first with fine header, but Keito Nakamura quickly equalise for Japan.

Crysencio Summerville later put di Dutch ahead again with a beautiful goal after one hour of play.

As Netherlands begin feel say dem don win, Daichi Kamada score late equaliser for the 88th minute to show dem say dem nor boil egg for di world cup.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds