world cup

19 Results / Page 1 of 3

Background

Sports

Okocha Tuk Why Nigeria Nor Dey Qualify Go Major Tournament

By: Kofoworola Olayinka Former Super Eagles captain Austin Okocha say Nigeria dey struggle cause dem nor  get proper home ground since di national team stop to dey regularly play match for Lagos. Okocha tuk dis one for OBI One Podcast, as e remember how Nigeria fail to qualify for di 2006 World Cup after dem draw 1-1 with Angola for Kano. Di former Bolton midfielder say playing such important match […]

todayAugust 19, 2026 8

Sports

Maresca Say Man City Problem No Be Only Because Rodri No Play

By: Kofoworola Olayinka Manchester City manager Enzo Maresca say Rodri na special player wey any team go miss when e no dey play. Maresca point to Rodri World Cup and Ballon d’Or success as proof say di midfielder dey important. But Maresca say fans no suppose blame all City problems on Rodri absence. He say di real matter na how the whole team dey perform, not only whether Rodri dey […]

todayAugust 17, 2026 9

Sports

Motsepe Say Election Go Decide Infantino Fate

By: Olabisi Olatunji CAF boss Patrice Motsepe say na election suppose decide Gianni Infantino fate as FIFA president, as Ireland don join countries wey withdraw dia support for am. Infantino dey under serious pressure after e face backlash over plan to sell part of World Cup ownership to private investors. UEFA, CONCACAF and AFC don also turn against am, accusing am of breaking di trust wey football bodies put for […]

todayAugust 13, 2026 19 1

Sports

Three Barcelona Players Don Return to Training After World Cup Break

By: Esther Daniel Barcelona players Joan Garcia, Eric Garcia and Anthony Gordon don return to training for di first time after dia World Cup break, as dem begin preparation for di new season. Di three players, wey represent Spain and England for di World Cup, train for weekend alongside Gavi through gym work and ball exercises. Di rest of di Barcelona squad get rest after di triangular tournament for Udine, […]

todayAugust 10, 2026 15 4

Sports

FIFA Boss Infantino Receive Heavy Blow As Top Adviser Quit Over World Cup Deal

By: Esther Daniel FIFA Presido Gianni Infantino don suffer big setback as him senior adviser Carlos Cordeiro resign on Friday over plan to sell part of di World Cup business operations. Cordeiro, wey be former US Soccer Federation president, talk say he no fit support di move because he believe say di deal no good for football. Di former banker and lifelong football fan explain say him decision come because […]

todayJuly 31, 2026 18

Sports

Cucurella Draw Spain Coachie Face On Top Him Body

Spain defender, Marc Cucurella, don honour World Cup-winning coach, Luis de la Fuente, by drawing di coach tattoo for him body after Spain win di World Cup. Cucurella help Spain beat Argentina 1-0 for di final, as De la Fuente lead di team to another international trophy. Di Real Madrid defender reveal di new tattoo for social media after him £52 million move from Chelsea in June. Di tattoo show […]

todayJuly 29, 2026 13

Sports

Messi Pass Yamal On Top World Cup Dribble Chart

Argentina captain Lionel Messi don climb reach number one for players wey don complete di highest successful dribbles for di ongoing FIFA World Cup, as e don overtake Spain wonderkid Lamine Yamal. Messi achieve dis record for Argentina dramatic 2-1 comeback win over England for Wednesday World Cup semi-final with nine successful dribbles and two assists. According to official FIFA World Cup statistics, di 39-year-old don record 24 successful dribbles, […]

todayJuly 16, 2026 26

Sports

Rice And Odegaard Go Face Each Other For World Cup Quarter Finals

By Oluwatosin Ibrahim Declan Rice of England and Martin Odegaard of Norway go meet each other for di FIFA World Cup quarter-final. Di two players be teammates for Arsenal Football Club in London, where dem help di club win di Premier League title and reach di UEFA Champions League final. But now, dem go stand against each other because Rice dey represent England, while Odegaard dey captain Norway. Both players […]

todayJuly 10, 2026 14

Sports

Zeki Amdouni Fit Retire From Professional Football Dis Week

Switzerland star, Zeki Amdouni, don yarn say he fit retire from professional football once he face Lionel Messi for FIFA World Cup. He yarn dis one for him Snapchat on Tuesday after Switzerland beat Columbia. Amdouni joke say after di match, he go just end im football career. Argentina wey be defending champions go jam Switzerland for quarter-final later this week.  

todayJuly 8, 2026 28

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds