Say like dis Guinness world record, dey monitor one 24-year-old hairstylist, Ikechukwu Damilola wey dem dey call “Transformation King,” wey wan break world record, say im don reach 90 hours out of 120-hour to break Guinness World Record hairdressing marathon for Lagos.
Di attempt dey happen for Oto-Awori Local Council Development Area for Ijanikin and GWR officials dey monitor am.
Chairmo of di LCDA, Mr. Kareem Abiodun, talk say di event dey show how important skill and youth development be.
Damilola say im dey push to finish di challenge by Monday.