Lagos

54 Results / Page 1 of 6

Background

Lagos

How Lagosians Take Fall Hand Rush Beer After Road Askident

Kwake, dem say, problem everywia, na yesterday for Ajegunle, wia one beer truck don go get askident with one dispatch rider and two vehicles for Abalti Barracks, as bottles of beer scatter for road and commuters rush to pick dem dey drink. LASTMA officials na so dem enter di area dey form defend, dey defend beer wetin nor gud. According by di LASTMA tok, tok, Adebayo Taofeeq, say the truck […]

todaySeptember 30, 2026 18

OBODO NAIJA

Baba Presido Drop Hin Mouth Odour For 2027 Opposition

For di Bad belles and  opposition, ogbonge update oh, baba, aka Jagaban, President Bola Tinubu  just land Lagos yesterday  from  holiday, incase u dey think say senior man dey sick, as senior man say  hin don ready for di 2027 race, person wey leg nor strong comot body. Na so e tell all di news tatafos for airport, comot body, comot body, energy dey fully 100 percent. Baba seyi say […]

todaySeptember 30, 2026 17

Education

NELFUND Increase Support For Nursing Students

By: Ayobami Dada NELFUND don increase support for nursing and midwifery students from N59.4 million to N811.9 million. Di money go reach students for different states, including Lagos, Oyo, Ogun and Cross River. NELFUND say di support go reduce financial pressure on. Di Fund say dem dey invest to produce more health workers for Nigeria.

todaySeptember 14, 2026 13 6

Business

Dangote Refinery IPO Go Start September 14, Nigerians Fit Buy Share for N5,250

By: Ayobami Dada Dangote tok for Lagos on Monday say di refinery put 4.1 billion shares for sale at N525 per share, and dem dey target 10 million Nigerians. Aliko Dangote tok say Dangote Refinery IPO go start September 14, 2026, and person fit start with just N5,250 to buy 10 shares. He say people fit buy di shares online through BVN, so ordinary Nigerians fit become part-owners of di […]

todaySeptember 8, 2026 12

Lagos

Sanwo Olu Tok Say APC Dey Ready To Win Lagos For Di 2027 Election

Lagos Govo, Babajide Sanwo-Olu, don talk say APC don ready well-well for di 2027 general election, as e dey confident say di party go carry victory for Lagos. Sanwo-Olu talk dis one on Monday after e waka go inspect APC presidential and gornorship campaign offices to see how preparation for di election dey go. Di Govo say di party campaign structure don dey set, as dem don start to dey […]

todayAugust 25, 2026 20 6

Lagos

LAWMA Lock Markets Over Dirty Environment

By: Yusuf Abuh LAWMA don lock some markets and plazas for Ayobo, Lagos, on Sunday over repeated environmental violations and illegal dumping. LAWMA Project WISE team carry out di enforcement around Ayobo-Ipaja axis to clear waste backlog and stop illegal dumping. LAWMA boss Muyiwa Gbadegesin say dem target facilities wey repeatedly break di environmental rules despite several warnings. Rock of Age Plaza, Ajerogun I Market, Ayobo Market and Oba Plaza […]

todayAugust 25, 2026 14

Lagos

FG Cut Carter Bridge Work From 36 To 24 Months

By: Yusuf Abuh Federal Gornment don reduce di timeline to complete reconstruction of Carter Bridge for Lagos from 36 to 24 months, wi Minister of Works Dave Umahi announce am on Monday during inspection of di project. Umahi, alongside Minister of State for Works Mohammed Goronyo and lawmakers, inspect Carter Bridge and Iddo Bridge projects for Lagos to speed up di work. Di minister say dem shorten di reconstruction period […]

todayAugust 25, 2026 18

OBODO NAIJA

Primate Ayodele Don Predict Say Tinubu Fit Move Nigeria Capital Go Lagos If E Win for 2027

By: Mariam Ajayi Primate Elijah Ayodele, Popular cleric don predict say Oga Presido Bola Tinubu fit move capital of Naija from Abuja go Lagos if e win di 2027 presidential election.   Di cleric make di prediction for one video for X as Tinubu dey prepare to get anoda term for office.   Ayodele say if Tinubu win again, Lagos architecture go change and di capital fit move to Epe, […]

todayAugust 21, 2026 17

Sports

Okocha Tuk Why Nigeria Nor Dey Qualify Go Major Tournament

By: Kofoworola Olayinka Former Super Eagles captain Austin Okocha say Nigeria dey struggle cause dem nor  get proper home ground since di national team stop to dey regularly play match for Lagos. Okocha tuk dis one for OBI One Podcast, as e remember how Nigeria fail to qualify for di 2006 World Cup after dem draw 1-1 with Angola for Kano. Di former Bolton midfielder say playing such important match […]

todayAugust 19, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds