By : Jolayemi Olajide
Lagos State gornment don announce say dem go lock Iddo Bridge for Ijora area sake of repair work wey dem dey do. Di Commissioner for Transportation, Mr. Oluwaseun Osiyemi, yarn dis one for inside one statement on Tuesday.
Di government talk say Federal Ministry of Works go use di time fix heavy steel beams make di bridge come strong well-well, so dem need to close di place make accident no happen.
Di road go close for two times: Wednesday, June 17, 2026, from 10:00 p.m. reach 5:00 a.m., and Sunday, June 21, 2026, from 8:00 a.m. reach 4:00 p.m. Make drivers and commuters come prepare so traffic no go jam una for those hours.