south west

Ogun Police Gbab Two Suspected kidnapers

todayJune 24, 2026 4

Background
share close

By: Emmanuel Ariyo-David

Operatives of Ogun State Police Command don go kpai two suspected kidnappers and recover gun, cash and other items during one follow-up operation linked to di rescue of one kidnapped victim.

Police talk say na officers from di Anti-Kidnapping Unit carry out di operation as part of efforts to fight kidnapping and other violent crimes for di state.

According to statement wey police spokesman DSP Oluseyi Babaseyi release on Wednesday, dem bin  kidnapped di victim on June 11, 2026, for Ogbe Village, Ogun State.

Immediately dem receive di report, police activate dia Anti-Kidnapping Unit and deploy intelligence and tactical teams wey help dem secure di victim freedom and track down di suspects.

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds