Senator Rabiu Musa Kwankwaso pay courtesy visit to former President Olusegun Obasanjo for Kano on Thursday night.
Obasanjo, wey dey Kano for official assignment, receive Kwankwaso for im temporary residence.
Statement wey Saifullahi Hassan release say Aminu Gwarzo join Kwankwaso for di visit.
Di statement no talk wetin di two leaders discuss during di meeting.
Â