Small moral don enter Super Falcons camp as midfielder Esther Okoronkwo return to action for AFC Toronto, playing 25 minutes as dem beat Vancouver Rise 3-1 on Sunday.
Di 29-year-old bin stay out for almost two months because of wunjury wey she suffer during one league match against Halifax.
Her comeback don give Nigeria better hope as di Super Falcons dey prepare for 2026 Women’s Africa Cup of Nations wey go hold for Morocco from July 25 to August 16.