Environmental agency for Lagos State, LASEPA, don cut chain follow one nightclub and hotel, say dem one use obule dey blind neighbours ear.
Small tin, obule, obule, obule, ahoo
Di two places wey dem seal on Monday dey for Olowora and one Suites inside Alapere, Ketu.
According to di statement wey di agency post for X on Tuesday, dem warn dem about niose population but di obule just dey enter head.
Dis enforcement dey follow di order of di Commissioner for Environment, Tokunbo Wahab, as di State Gornment dey try to protect di health of Lagos residents.