Problem dem say e nor dey finish oh, dat Fuel marketers don sama beta warning give federal gorment say, if dem get two head, try am, control dia petrol pump price, dem go luck filling station.
Oga tuk, tuk, IPMAN, di fuel sellers, Chinedu Ukadike, naim use im yamchop mouth tuk dis one, say dem nor go accept any policy wey go force dem sell fuel for fixed price.
Di warning come after Minister of State for Petroleum Resources (Oil), Heineken Lokpobiri, say gornment nor go allow anybody exploit fuel consumers through excessive pricing.
Dem nor understand oil price go chep fro obod oyinbo, den Nigeria filling stations go do wetin dem like, and dat, e nor go work