By: Yusuf Abuh
Wi oga Presido, Bola Tinubu on Tuesday don launch ogbonge special quad wey dem dey call Presidential Working Group on di National Policing Bill, to map di way for Naija state police
Na Chief of Staff, Femi Gbajabiamila, stand in for di Presido to open di committee group for inside di Presidential Villa for Abuja.
Dis move dey happen after di National Assembly pass di new law wey allow make Nigeria get two types of police di Federal Police Service and separate police for di 36 states.
According to di Presido spokesman, Bayo Onanuga, di main work of dis new bill na to set proper road on how di state police go take operate across di country.