south west

Ogun Police Rescue Abducted Prince, Kill Two Kidnappers

todayJuly 10, 2026 10

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Ogun State Police Command don rescue Prince Idris, one prince from Okun Owa for Odogbolu Local Government, after kidnappers jaguda go carry am comot from im house on June 30.

According to police tuk, tuk person, DSP Oluseyi Babaseyi,  wey konfam dis mata, dem put serious pressure on di kidnapping gang before intelligence operation lead to di killing of two kidnappers.

During di operation, police recover one AK-47 rifle, one empty magazine, two phones and one bag wey dem suspect say kidnappers use collect ransom.

Babaseyi, say investigation still dey continue as dem dey pursue oda members of di gang.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds