OBODO NAIJA

Imo Govo Uzodimma Greet Oyo Families as Kidnap Victims Regain Freedom

todayJuly 11, 2026 6

Background
share close

Imo State Governor, Hope Uzodimma, don hail wi oga  Presido Bola Tinubu and security agencies over di successful rescue of di school pikin dem and teachers wey bandits kidnap for Oriire, Oyo State.

Im put dis one for statement say di operation show say Federal Gornment dey serious about protecting Nigerians .

Uzodimma express joy say all di victims reunite with dia families after 56 days for captivity without any ransom payment or deal with di kidnappers.

E still congratulate di parents of di victims and di pipo of Oyo State, saying di rescue show say Nigeria no go abandon her citizens.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds