National

President Tinubu Give Kudos to Security Agencies Over Oyo School Pikins Rescue

todayJuly 11, 2026 11 2

Background
share close

Edited by Ebi Oboko

Wi oga Presido, Bola Tinubu don express joy as security agencies rescue di school pikin dem and teachers wey kidnappers hold for 56 days for Oriire community, Oyo State.

Baba Seyi  hail di military, DSS and Nigeria Police for di successful operation wey lead to di arrest of eight suspected kidnappers while security operatives neutralise oda gang members.

Tinubu also sympathise with di victims and dia families over di trauma wey dem pass through during dia captivity.

E still praise Oyo State Government for working with di Federal Government and urge di state to tighten security around schools to stop future attacks.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds