Lagos

Lagos Court Sentence Man To Kpai By Hanging

todayJuly 13, 2026 6

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Lagos State High Court wey dey sit for Ikeja don sentence Justice Odey to death by hanging after court find am guilty say e kpai 35-year-old woman, Benedict Agara.

Court hear say di killing hapun on April 3, 2021, for Jakande Housing Estate, Lagos, during one fight wey involve one woman wey dem identify as Amina.

Justice Modupe Nicol-Clay rule say prosecution prove di murder case beyond reasonable doubt under Section 222 of Lagos State Criminal Law, 2015.

Police investigator ASP Mariam Ibrahim testify for court, while prosecution present six exhibits before judgment wey lead to di death sentence.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds