As di 2026 World Cup don enter Semi Finals, Spain and France go play by 8pm dis night, na so tension dey full bodi.
But Spanish wonder boy, Lamine Yamal no send either tension or pressure as e go post picture of di 5-4 victory wey Spain knack give France for 2025 UEFA Nations League Semi Finals.
Yamal drop dis post for him Instagram story on Tuesday to remind France say everywhere choke and make dem also see am as threat against dia defense.
And for interview with tori pipo, he sti fry mouth put say na only Spain fit beat France and dat dis na di most important match of him career.