Lagos

Gateman Pack Full Dorti Throway Inside Gutter

todayJuly 14, 2026 8

Background
share close

Di Lagos state government don gbab one man wey dey throway dorti inside gutter for No. 18 Oluoga Ikorodu on Tuesday.

Dis one dey for inside video wey di commissioner for environment and water resources, Tokunbo Wahab post for Instagram on Tuesday.

Inside di video, Mr John Ehidreme, wey be gateman for one school carry one full bin of dorti dey pour am inside gutter, another woman sef no carry last as she sef pour her own inside.

Lagos State Gornment don remind residents say to dey dump refuse anyhow na against environmental law because e dey block drainage, cause flood and put public health plus environment for risk.

Government dey beg residents make dem throway their refuse well and use only approved waste management services.

 

Video on Instagram: https://www.instagram.com/reel/DayC9jcoKi_/?utm_source=ig_web_copy_link&igsh=MzRlODBiNWFlZA==

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds