National

Police Officers Cast Demsleves Go Collect Bribe Of N53,000 From ICPC Chairmo

todayJuly 20, 2026 7

Background
share close

By: Esther Daniel

Four police officers don land for wahala after dem allegedly collect N53,000 from  Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission,  ICPC Chairmo, Dr Musa Aliyu, during illegal stop-and-search operation for Banex area of Wuse, Abuja.

FCT Police Commissioner, Ahmed Sanusi, yarn on Monday say di officers abandon dia official duty posts, mount illegal checkpoint and no know say di man wey dem stop na ICPC oga.

According to am, dem force Aliyu withdraw N53,000 through POS, pay transaction charge join before di officers share di money among themselves.

Sanusi describe the officers as “thieves” and say dem no deserve to wear police uniform as investigation dey continue.

 

 

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds