NIGERIA POLICE

23 Results / Page 1 of 3

Background

Politics

Police Chief Say 2027 Election Go Secure

By: Kofoworola Olayinka Naija Police Chief, Olatunji Disu, don assure Nigerians say police go make sure everybody vote safely during di 2027 election, despite kidnapping, terrorism and election violence wey still dey worry pipu across di country. Disu tok am during one sit-down interview, saying police dey train officers well-well to handle election security and make sure voters fit cast dia votes without fear. E also say pipu for northern […]

todaySeptember 14, 2026 8

OBODO NAIJA

Police Arrest 22-Year-Old Man For Suspected Defilement Of 15-Year-Old Girl

By: Mariam Ajayi Police don arrest 22-year-old Daniel for Ogun State over allegation say e drug 15-year-old girl with malt drink before e allegedly defile her. Force spokesperson Ani Iniedu confirm di arrest in a statement on Sunday, saying di girl lose consciousness after she drink di malt. Police take di victim go Olukoye Ransome-Kuti Memorial Hospital for Asero for medical check-up, while dem carry di suspect go custody.

todayAugust 31, 2026 12

OBODO NAIJA

Police Track N3.6bn Yahoo Money From Crypto

By: Mariam Ajayi Nigeria Police Cybercrime Centre, don trace more dan N3.6 billion suspected criminal money tru cryptocurrency conversion scheme. AIG Akaninyene Ezima disclose dis for Abuja, saying one Business Email Compromise suspect don make over N100 million from cyber fraud. E also say investigation into sextortion and romance scam uncover several victims linked to di same criminal identity.

todayAugust 27, 2026 11

Local

Security Operatives Rescue Nine Kidnap Victim For Kogi-Edo Border

By: Kofoworola Olayinka Security agency don rescue nine kidnap victim for Kogi-Edo border after joint operation on August 11. Two commissioners inspect police and other security workers wey dey carry out seven-day operation for forest areas and hideout. Police spokesperson ASP Afusat Salihu say di operation improve intelligence sharing and coordination against security threats. She say police, Army, Navy, DSS, NSCDC and local vigilantes rescue di victims and reunite dem […]

todayAugust 14, 2026 14

Entertainment

VDM Join Police Raid Alleged Baby Factory For Abuja Over Seven-Day-Old Baby Sale

By: Esther Daniel Social media activist, Martins Vincent Otse, popularly known as VeryDarkMan (VDM), don join operatives of di Nigeria Police Force Special Tactical Squad (STS) for raid of one alleged baby factory for Karshi area of Abuja. Di operation happen after allegation come out say dem dey sell one-seven-day-old baby. VDM share videos of di operation for im official social media page, e show how e follow police officers […]

todayJuly 22, 2026 27

OBODO NAIJA

Police burst pipeline vandal syndicate, arrest seven suspects for Adamawa

By : Jolayemi Olajide Police don arrest seven people wey dey vandalise NNPC pipelines for Adamawa State. Police tok for statement on Wednesday say officers recover 285 pieces of vandalised pipelines during di operation. Police say dem stop one J5 bus wey carry di pipelines for Yola-Numan Road after intelligence report. Investigation still dey continue as police dey find other people wey join for di crime.  

todayJuly 22, 2026 13

OBODO NAIJA

ICPC uncover 908 ghost workers, recover N942 million

By : Jolayemi Olajide ICPC don uncover 908 ghost workers for over 50 federal MDAs and recover about N942 million wey dem allegedly pay through fake salary scheme after investigation begin for 2024. ICPC Chairman Musa Aliyu siddun tuk say di probe start after commission notice mago mago for pension payments and expose payroll fraud. Aliyu allege say some senior public officials put dia relatives and associates for government payroll […]

todayJuly 22, 2026 14

OBODO NAIJA

IGP Disu Warn Police Bosses Against Illegal Detention

By: Esther Daniel Inspector-General of Police, Olatunji Disu, don warn Commissioners of Police across Nigeria make dem stop illegal detention of suspects, abuse of office and any form of misconduct. Di IGP give di warning during meeting wit Police Strategic Managers for Goodluck Ebele Jonathan Peacekeeping Hall for Abuja, where e remind police commanders say discipline and professionalism must remain top priority. Disu tuk say Commissioners of Police get responsibility […]

todayJuly 22, 2026 16

OBODO NAIJA

FCT Police Boss Warn: No Gree Make Police Search Your Phone

By: Esther Daniel Di Commissioner of Police for Federal Capital Territory (FCT), CP Ahmed Sanusi, don tell residents, especially young people, make dem no allow any police officer search dia phone during stop-and-search operations. E give di warning on Tuesday during one press conference. According to am, di Inspector-General of Police don already ban random phone searches because some officers dey abuse di practice to extort people. Sanusi say no […]

todayJuly 21, 2026 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds