Politics

 Kwankwaso Say Obi Sign One-Term Agreement

todayJuly 21, 2026 6

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Vice-presidential candidate of National Democratic Congress, Rabiu Kwankwaso, don confirm say im and presidential candidate Peter Obi sign written agreement wey say Obi go serve only one four-year term if dem win di 2027 presidential election.

Kwankwaso tok dis one on Monday during one siddon-tuk, saying e believe Obi no go break di promise because di agreement no be ordinary mouth talk.

According to am, dem put di agreement for paper, with one document for di party and another one between both of dem.

Kwankwaso explain say di agreement be say after Obi complete one term from 2027 to 2031, power go return to Northern Nigeria through agreement of di party members and stakeholders.

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds