By : Jolayemi Olajide
Burkina Faso military leader Ibrahim Traore don warn say nobody fit lead di country apart from am, as e dismiss rumour of power struggle inside di junta on Thursday for Ouahigouya.
Traore tok dis for news statement say “two capons nor fit dey for di same boat.
According to Traore, any person wey im go catch do nonsense go face di music.
Rumours of infighting start after two top junta officials, Oumarou Yabre and Farouk Azaria Sorgho, stay away from public for long time.