OBODO NAIJA

Boko Haram release obituary for media operative wey soldiers kill

todayJuly 22, 2026 2

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Boko Haram don release obituary video for dia media operative, Abu Salim al-Barnawi, wey Nigerian troops kill during failed attack on military base for Borno State last week.

Operation HADIN KAI Acting Media Information Officer, Captain Mohammed Goni, siddun tuk on Wednesday say terrorists lose dia cameraman during di fierce battle for Lake Chad Basin.

According to Goni, al-Barnawi bin dey lead attacks into Cameroon before e later join Boko Haram media wing as cameraman.

Di three-minute video show al-Barnawi with communication gadgets before im death, as military continue operations against di terrorists.

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds