By: Esther Daniel
2027 presidential candidate of di Nigeria Democratic Congress (NDC), Peter Obi, don blast Presido Bola Tinubu Renewed Hope Agenda, describe am as “failure and renewed hopelessness.”
Obi tok during interview for Channels Television Sunday Politics programme say if Nigerians elect am as Presido, e go give dem real and tangible hope wey everybody go see.
According to am, Tinubu policies never improve di lives of ordinary Nigerians and dem never give people confidence about di future.
Obi also reject comparison between im plan to rebuild Nigeria economy through production and Tinubu Renewed Hope Agenda, insist say both plans no be di same.