By: Yusuf Abuh
NAFDAC don begin fresh movement to close down sachet alcohol products, some pipo im coconut head sti dey sell shecet alcohol.
Di agency Director-General, Mojisola Adeyeye, talk dis during press briefing on Tuesday for Lagos, saying di move na to protect children, teenagers and vulnerable people from alcohol abuse.
Adeyeye say NAFDAC dey work with health and consumer protection agencies to make sure di ban take full effect and people understand di danger.
Di agency warn say dem no go stop monitoring as dem push to end production and sale of di banned products across Nigeria.