Lagos

Lagos Dey Plan Special Number Plates For Pipo Wey Get Disability

todayJuly 29, 2026 6

Background
share close

Lagos State Gornment don begin plan to introduce special vehicle number plates for people wey get disability, so movement fit easier and everybody fit enjoy equal access across di state.

According to statement from di state gornment, Lagos State Office for Disability Affairs, LASODA, and Lagos State Motor Vehicle Administration Agency, MVAA, na dem dey work together to bring di plan to life.

Di idea come after LASODA management visit MVAA, where both agencies discuss how dem go create and implement vehicle identification system wey go favour people wey get disability.

Permanent Secretary of MVAA, Abdulrasheed Muri-Okunola, tok say di special number plates go help achieve Govo Babajide Sanwo-Olu vision of building Greater Lagos wey no go leave anybody behind.

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds