Sports

Osimhen Score as Galatasaray Draw 3-3 With Rennes

todayAugust 3, 2026 5

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Victor Osimhen score one goal as Galatasaray play 3-3 draw with French club Rennes for pre-season match on Sunday, but di Turkish champions still never win any of dia three friendly games.

Osimhen open di scoring for Galatasaray inside di 18th minute before Esteban Lepaul equalise, later score two more goals complete hat-trick and put Rennes ahead 3-2.

Gabriel Sara also score for Galatasaray before Baris Yilmaz use late penalty for di 94th minute take rescue the draw.

Galatasaray go face Spanish side Villarreal next Saturday for dia final pre-season game before dem begin defence of dia Turkish league title against Corum.

 

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds