By: Esther Daniel
Ukraine don launch overnight attack on Monday wey hit two Wildberries warehouses, while anoda site wey dem believe say get link with Russia biggest online shopping company also suffer damage near Moscow.
For di past few weeks, Ukraine don dey target Wildberries facilities, wey plenty pipo dey call “Russia Amazon,” as part of dia attacks.
Local officials tok say at least five pipo die and 10 oda pipo injure for one industrial site about 69 kilometres from Kremlin, but dem never confirm whether na Wildberries own di place.
For St. Petersburg and Tver regions, officials don confirm say Ukraine strike also hit two oda Wildberries warehouses