By: Yusuf Abuh
Monaco dey prepare to part ways with Paul Pogba as both sides don start talks to end di midfielder contract before time.
Pogba join di French club last summer on two-year deal after he return to professional football following 18 months doping suspension.
But injury disturb him first season for Monaco and e limit di number of matches wey he play, even as dem hope say e go play more games dis season.
Now, di arrival of new Monaco coach Filipe Luis fit change di club midfield plans and push di former France star closer to di exit door.